Lucifer adjusts his robes as he perches himself on a stool.
Uriel glances at the celestial time and sighs, impatient to be about his business.

“Honestly, I did’t do anything THAT BAD”
“Udonmeanit…”
The sarcasm flies over Lucifer’s head.
“Serious o. I only said me too I want in on the good good na. You know what they say…”
“I don’t…”
Interrupts.
“What’s good for the goodse, is good for the gander! See what i did there? See?”
A big smile on L’s face.
“E for Effort”
Lucifer frowns and smacks his teeth. “Abeg abeg. Na wa you sef! Anyway! Back to my side of the story! Yes ooooo. Small tin like dis. Oga come dey vex! Allova sudden, I don turn Devil. Juslaidat!”
A raised eyebrow. “If HE was angry, then it was not a small thing
He eyes his companion. “So you been dey dere wit me wen e happen abi?”
His companion sighs. “Carry on”
“Ehen. So I say me I want my own throne. Me sef i want my own praise. Ahn ahn! I don dey shout Halleluyah since HE make me! E never do? Me sef why i no go siddon, dey drink cold water?”
A shocked look on Uriel’s face. “You said what?”
“Ear dey pain you!? I tell am say, Bros G, Me sef i want seat. E no need big like your own. Juss small ting wey i go take siddon beside you so we go share the praise. Not even 50-50. 80-20 na im i talk. Oga come vex”
Uriel’s mouth drops open.
“Hayyyyyy! You have no fear?? Are you mad???”
“Ahn ahn! Is it because I’m telling you something you are now insulting me anyhow? Take ya time o! Anyway! He sha was vexing for me and said i should get out. Ah. After all my loyal service. This life sha.”
Uriel shakes his head. “See, I have 12pm Hosanna duty and it’s almost time. What exactly do you want me to do for you? Beg HIM?”
Lucifer laughs, playfully slapping Uriel’s shoulder. “Beg ke! O ti o. No beg please. Why i go beg am. A whole me! Lucifer! Finest boy in H Town. Baby boy of Life! Ehhhhhnnnn”
He dusts his shoulder.
“So..what then?”
“Ehn. Mo nlo! I dey port! I’m porting outta here so i came to give you proposal, you know we are friends na. Egbon mi!!!!”
Uriel huffs, irritated. “Get to the point! Goodness!”
“Ahn caam daan na. No be Halleluyah you just wan go shout? E no dey tire you sef! Anyway Come and follow me o! I’m going to Earth to control everything! Controller general and tinz. Your boy is gonna blow! If you follow me, i fit make you Deputy Commander because we don be padi for long mehn…”
Uriel stands to his full height.
“Lucifer! Lucifer! Lucifer! How many times did i call you?”
“Ahn ahn na wetin!”
“E be like say you don crase finish abi! So you look me upandan finish, think say na me go follow you chop eternal punishment. You tink say i no know dat be your punishment?? Eez like ya a mad somebody. Belly don dey run you abi? So you look Daddy G.O throne finish and e dey do you WAWUUUUU, you come go challenge am”
“Eiiissss…”
Uriel interrupts. “Ehn! I no wan hear! Do me a favour please. GERRARAHIA! GERRARAHIA RIGHT NOW!”
“Whoolup nigga! Whoolup! Ahn ahn dem no dey follow you play again?”
“Abeg! Carry your play dey go! DEY GO!”
Lucifer angrily gets up.
“Oya dey here na! You too dull sef!  You don fall my hand, guyyyy. Ahn! You don forget na me and you dey hustle for Ojuelegba from day one”
Uriel sharpens his sword on the floor. “You still dey here???”
He lashes out with his sword at Lucifer and he flees, cursing.
Uriel chases after him.

Minutes later, Uriel comes back and sighs deeply and looks at you, the reader.
“E don be for una sha… That oloriburuku go frustrate una die. Ehyaaa…”

————————————–

In my head, the Devil is a disgruntled Nigerian civil servant.